EFCC say dem monitor Ondo state election to find vote buying and selling
Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) say dia men dey ground for Ondo state to find pipo wey involve in vote buying and selling during di election.
According to informate for dia X page, di commission say dem monitor di election to ensure say dem check everi form of electoral offences wey go happun.
"Operatives dey all ova di state in line wit di mandate of di commission to prevent, investigate and prosecute all forms of economic and financial crimes," EFCC tok.Meanwhile, counting for di 2024 Ondo state election don begin.