Yiaga Africa say case of vote buying dey for Ondo govnorship election

Wia dis foto come from, X/Yiaga Africa
Yiaga Africa, one civil society organisation wey dey chook mouth into electoral matter tok say dem observe cases of vote buying for different polling units for di ongoing Ondo state govnorship election.
Di group tok dis one wen dem dey give dia situation report about di election wia dem tok say dis issue of vote buying dey contribute to electoral corruption.
Remember say BBC capture moments wey some voters begin collect money afta dem cast dia votes for di Ondo State govnorship election. Di open vote-buying occur for unit 016, Ahmadiyya Grammar School, Owo local goment area.
But one oda incident wey Yiaga mention happun for St. Stephen Polling Unit in Ward 4, Akure and men of di DSS bin gbab di pesin wey dey involved for di mago-mago.
Di group say election officials and materials bin arrive early for polling units wey dem observe.




