BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
'Mary Habila na like daughter to me' - Minister Umahi break silence over staff death
David Umahi, tok-tok pesin, Francis Nwaze say Habila na employee of di David Umahi Federal University Teaching Hospital.
US House of Reps pass bill to withhold all assistance to Nigeria until kontri address terrorist attacks
Gregory Stuebe, wey dey represent Florida 17th congressional district for di House, bin propose di amendment on Wednesday.
Ghana go conduct independent autopsy as bodi of citizen wey dem kpai for South Africa return home
Ghana authorities dey demand justice for citizen Bashiru Isak wey dem kill for South Africa as im bodi arrive for di kontri.
Full list of property wey link to former Justice minister wey court forfeit
EFCC bin file di suit to di permanent forfeiture of di 57 properties wey worth 212.8 billion naira ($154 million), wey dey linked to Malami.
Ova 300 more Nigerians arrive from South Africa - wat next?
Nigerian govment bin start di repatriation exercise to evacuate dia nationals wey wan comot for South Africa sake of di anti-immigration wahala for di kontri.
South Africa anti-immigration leader shot dead, police begin investigation as five suspects impersonating Home Affairs chop arrest
Dem shoot March and March Guateng leader Andile Mvuyelwa Somgxada for outside im home on 4 July, few days afta di June 30 protests.
Wetin we know about arrest of content creator Odogwu Asaba over death of 21-year old woman
Police explain say wen she bin land for Asaba, di suspect allegedly carry her go hotel wia im allegedly raped her and subject her to physical violence.
Authorities arrest Adeniyi Adeyemi ontop fake agency PFIPC afta court arrest warrant
Abuja court don oder make dem arrest Adeniyi Adeyemi, wey present imsef as di Director-General of Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC), e dey face criminal charges for di running di fake agency.
Appeal court put spanner for ADC congress, party counter Nafiu Bala list for 'Inec portal'
Tori dey fly upanday say one faction of ADC don upload details of dia candidates for Inec portal but ADC say na fake tori
Special Tori
Wetin we know about Chidinma Adetsina court case for South Africa
Di former Miss Universe dey face deportation charges afta she enta di kontri illegally sake of her 2024 ban by South Africa authorities.
100,000 companies dey affected as CAC begin strike off names from register - wetin businesses fit do
CAC say dem go strike off di name of all di affected companies, as part of dia efforts to clean dia register and comot ineligible companies.
Burkina Faso, Uganda, Niger and oda kontris on America 'do not travel list'
Ten of di kontris for di list na from di African region - dem include Burkina Faso, Uganda, Democratic Republic of Congo, Mali, Niger, Sudan, among odas.
Medical waste or miracle cure? Why pesin go wan smuggle human placenta?
A criminal investigation for Pakistan don discover allegations of human placentas wey dem dey smuggle from hospitals for anti-ageing treatments.
Ghana authorities go begin repatriation of 'final batch' of 900 citizens from South Africa on 25 July
Ghana authorities dey expected to begin fresh repatriation of citizens from South Africa on 25 July in wetin dem describe as 'final batch' of evacuations.
'I no believe say dis go be im last operation' - Papa of soja wey die for Oyo kidnap rescue operation
According to di papa of di late soja, di Army no gree to dia request to release dia son deadi bodi.
Suspected herdsmen kill eight for gun attack during burial for Benue
Eight pipo don die afta gunmen attack Otukpo-Nobi for Benue State on Sunday night.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.














































