You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Inec postpone Enugu East senatorial election

Di independent national electoral commission (INEC) say a total over six million pipo never collect dia permanent voters card two days to di Nigeria presidential and national assembly.

Live Coverage

Victor Ezeama and Jelilat Olawale

  1. More on how court dismiss all oda reliefs APM bin ask for

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Di Presidential Election Petition Court don dismiss all di reliefs wey APM ask for.

    Dis na afta dem consider di evidence wey dem bring before di Appeal Court.

    Di chairman of di panel of five justices hold say dii entire grounds centre on di issue of alleged invalid nomination of Sen. Kassim Shettima.

    And afta dem consider all di paragraphs of di petition and di reply by di respondents, wetin happun be say being a serving senator of Borno central senatorial district, im nomination dat time as vice president bin amount to double nomination.

    But, dem say qualification on non-qualification of a candidate dey clearly stated for di constitution and Supreme Court don decide upon di issue plenti ttmes.

    No oda law fit contradict di constitution dem tok.

    Di petitioner from di oral and documentary evidence fail to establish any concrete reasons on why dem go grant im prayers.

    On di allegation of APC not conducting any primary election to nominate di Vice president, dme say di petitioner no correct as e dey within di constitutional power of di president to nominate im running mate and di position of di petitioner dey therefore discountenanced.

    Having resolved all di issues against di petitioner, di petition no get any merit, dem tok.

  2. Breaking, Court strike out issue of Shettima double nomination

    Di Presidential Election petition Court don strike out di petition of di Allied Peoples Movement for lack of merit and abuse of court process.

    Di court afta dem consider di grounds of di petition wey dwell on alleged invalid nomination of Senator Kashim Shettima as di vice president say di presidential petition court lack di jurisdiction to consider di mata sake of say na pre-election mata wey di petitioner suppose don settle for di Federal High court.

    Court add say di process of qualification of any candidate for any election dey inside di constitution particularly for section 131(1) so diafore, di petition wey APM bring dey incompetent.

    Di five-man panel of Judges don sit down and dem don begin address di issues wey di petitioners raise one by one.

  3. Ogbonge APC politicians dey inside court

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin

    Top APC politicians also dey inside court.

    Vice President, Kashim Shettima, Kogi state Govnor, Yahaya Bello, Femi Gbajabiamila wey be current Chief of Staff to di president, Imo state Govnor, Hope Uzodinma show face for court.

    Odas na Festus Keyamo and Nuhu Ribadu.

  4. Presidential court dismiss petitions of Obi, Atiku & APM for lack of merit

  5. Di five judges wey go decide Tinubu fate on di 2023 presidential election

  6. Why Court of Appeal agree to show presidential election judgement live on television

  7. Tori say former NDDC oga Lauretta Onochie dey stranded for UK - Wetin we know

  8. Palliatives - Items wey Nigeria govnors dey share give dia pipo to take manage subsidy removal

  9. 'Crocodile' Mnangagwa win re-election as Zimbabwe president

  10. Youth corps member no qualify to be Nigeria minister - Falana

  11. Election observers criticise Zimbabwe election

  12. How Lagos Assembly reject Abayomi, Omotoso and 15 odas as Sanwo-Olu commissioner nominees

  13. Who dey President Tinubu top team?

  14. UK police charge Diezani Alison-Madueke wit bribery

  15. 'We go confront her' - CBN react to video wey show Tinubu new minister dey 'abuse' naira

  16. Make una work to restore public faith in goment - Tinubu charge new ministers

  17. Tinubu appoint minister of Niger Delta development, make changes for ministerial positions

  18. SA on graveyards, ministry of happiness, SSA on house pool & oda appointments wey dey 'one kain'

  19. Wetin Blue Economy mean for Nigeria and oda tins di new minister go do

  20. Takeaways inside Tinubu ministerial portfolios wey you fit no sabi