Ten-man Fulham hold Arsenal to draw, Man United come from behind to beat Forest

Live-text commentary of Premier League matches wey involve Arsenal v Fulham and Manchester United vs Nottingham Forest

Live Coverage

Moseph Ekine

  1. GOAL, Man Utd 0-2 Nottingham Forest

    4 mins

    Wetin dey occur?

    Nottingham Forest score again through Wily Boly.

  2. GOAL - Forest score United, Man Utd 0-1 Nottingham Forest

    2 mins

    Straight from di start di away side don take di lead through Taiwo Awoniyi

  3. GOAL - Fulham take early lead!, Arsenal 0-1 Fulham

    1 min

    What a sart!

    Mistake from Bukayo Saka see di midfielder give di ball away to Andreas Pereira wey run straight into di Gunners half.

    Aaron Ramsdale di Arsenal goalkeeper dey out of position and e fires a curling shot into empty.

  4. Arsenal go win again?, Arsenal vs Fulham

    Arsenal players celebrate

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Arsenal na di first of three teams wey still get 100% record in Premier League dis season and dem go hope to extend am.

    Dem go host London rivals Fulham for di Emirates and dem be favourites to win.

    In fact, just to underline that, di Cottagers never win any away match against Arsenal in any competition (D6, L25), including all 30 league fixtures. Na di most one team don face anoda away from home without winning in English league history.

    Fulham dey winless in dia last 10 Premier League games against Arsenal (D2, L8) and don fail to keep clean sheet in any of dia past 16 games against di Gunners.

  5. Match Facts, Arsenal vs Fulham (15:00BST)

    • Arsenal dey undefeated in their last 16 home matches against Fulham in all competitions.
    • Arsenal don score at least 2 goals in 7 of their last 8 matches against Fulham in all competitions.
    • Fulham never win Arsenal for dia home in 30 attempts
  6. Team news - Saka break Arsenal club record, Palhinha start for Fulham, Arsenal vs Fulham (15:00 BST)

    Arsenal make two changes to di side wey beat Crystal Palace 1-0 on Monday.

    Takehiro Tomiyasu dey banned afta im receive two yellow cards for that match and Jakub Kiwior come in for am.

    Leandro Trossard start in place of Eddie Nketiah wey drop to di bench.

    Gabriel Jesus return to di bench and fit make e first appearance of di season afta e recover from knee injury.

    Bukayo Saka set a new club record by playing in 83 consecutive Premier League matches, meaning say e don bypass Paul Merson wey previously hold di record.

    Arsenal XI:Ramsdale, Kiwior, White, Saliba, Partey, Odegaard, Rice, Havertz, Saka, Trossard, Martinelli.

    Subs:Raya, Gabriel, Jesus, Smith Rowe, Nketiah, Jorginho, Vieira, Nelson, Zinchenko.

    Arsenal lineup

    Wia dis foto come from, BBC Sport

    Fulhamalso make two changes to di side wey lose 3-0 against Brentford last Saturday.

    Captain Tim Ream dey suspended afta e see red during di defeat and Calvin Bassey replace am, dis na di Nigerian first start for di club since e sign from Ajax in di summer.

    Joao Palhinha start in place of Harrison Reed afta e comeback from injury as a substitute last week.

    Fulham XI:Leno, Tete, Diop, Bassey, Robinson, Palhinha, Lukic, Pereira, Wilson, Jimenez, De Cordova-Reid.

    Subs:Rodak, Tosin, Reed, Cairney, Adama, Muniz, Mbabu, Vinícius, Harris.

    Fulham lineup

    Wia dis foto come from, BBC Sport

  7. Ten Hag name Eriksen and Martial for Starting XI, Man Utd vs Nottingham Forest (15:00BST)

    Erik ten Hag make three changes to di Manchester United side wey start di defeat against Tottenham last weekend.

    Luke Shaw and Mason Mount dey out injured, Alejandro Garnacho drop to di bench and Diogo Dalot, Christian Eriksen and Anthony Martial come into di starting XI.

    Manchester United XI:Onana, Wan-Bissaka, Varane, Martinez, Dalot, Casemiro, Eriksen, Antony, Fernandes, Rashford, Martial.

    Subs:Henderson, Lindelof, Maguire, Sancho, Pellistri, McTominay, Fernandez, Gore, Garnacho.

    Man Utd lineup

    Forest make two changes to di side wey beat Sheffield United last time out.

    Ryan Yates and fit-again Ola Aina start in place of Orel Mangala, wey no dey di squad, and Neco Williams.

    New signing Gonzalo Montiel dey among di substitutes.

    Nottingham Forest XI:Turner, Boly, Worrall, McKenna, Aurier, Danilo, Yates, Aina, Johnson, Gibbs-White, Awoniyi.

    Subs:Horvath, N Williams, Kouyate, Wood, Niakhate, Elanga, Freuler, Montiel, Hwang.

    Forest Lineup
  8. MATCH FACTS, Man United vs Nottingham Forest

    Head-to-head

    • Manchester United don win their past 10 games against Nottingham Forest for all competitions, including all four meetings last season by aggregate score of 10-0.
    • Forest don register one victory in 12 Premier League meetings with di Red Devils, dem draw two and lose nine.
    • That only win come for Old Trafford, a 2-1 victory for December 1994 wit goals from Stan Collymore and Stuart Pearce. Eric Cantona score for di home side.
    • Forest only goal in their past six matches wit Manchester United come from Alan Rogers wey score am for 8-1 defeat for di City Ground in 1999.
  9. Welcome!

    Good afternoon!

    Welcome to dis live-text commentary of di Premier League games between:

    Arsenal vs Fulham

    Manchester United vs Nottingham Forest