, Arsenal 0-1 Fulham
46 mins
Di players don return to di pitch.
Play don resume wit Arsenal taking di first kick.
Before di restart, Nketiah come on for Trossard.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Live-text commentary of Premier League matches wey involve Arsenal v Fulham and Manchester United vs Nottingham Forest
Moseph Ekine
46 mins
Di players don return to di pitch.
Play don resume wit Arsenal taking di first kick.
Before di restart, Nketiah come on for Trossard.
Arsenal 0-1 Fulham
Man Utd 1-2 Nottingham Forest
Brentford 1-0 Crystal Palace
Everton 0-0 Wolves
Pesin go fit breathe small afta dat first half.
Both Arsenal and United concede inside di opening matches of dia halves.
But di two of dem don respond to going behind by controlling di game.
Dis match be like goals still plenty inside especially wen you consider di way e start.
Forest race into 2-0 lead inside di first five minutes through Awoniyi and Boly.
Eriksen pull one back for di Red Devils just afta di quarter hour mark.
Much still dey to play for dis one.
Both teams go into di break but na Fulham dey lead here.
Di away side capitalise on Saka mistake to gift Fulham di lead.
45+2 mins
Morgan Gibbs-White enta di ref book.
45+1 mins
We don added time for di first half as di ref signal two added minutes.
Arsenal dey control tins but neva fit find di goal dem want.
44 mins
Serge Aurier enta di ref book as im pull back Antony.
First yellow of di game.
41 mins
Arsenal tink say dem don score through Martin Odegaard.
But Kai Havertz wey cut di ball back for di Norwegian don enta offside.
Good call from di linesman.
40 mins
United fans call for penalty as Antony go down inside di box.
Referee give corner instead.
Di Brazilian dance im way inside di box but Aina produce good tackle to stop am.
35 mins
Nottingham Forest work di ball well down United left hand side.
Brennan Johnson dey trhough before im try to find Awoniyi in di centre, Varane block di ball well if not e for be good chance for di away side to increase dia lead.
31 mins
Saka wit a good chance to bring Arsenal back into di game? No.
Di 21-year-old head di ball just over.
Soon afta Martinelli test Leno for Fulham goal wit a shot di goalkeeper palm out for corner.
28 mins
Fulham dey take di game to Arsenal as na dem don get di beta chances.
Martin Odegaard and di Arsenal team be like dia minds dey elsewhere as di Gunners captain needlessly give di ball away.
27 mins
Casemiro, oh!
Di Brazillian head di ball wide from just two yards.
24 mins
United don up di tempo on Forest.
Rashford dey look dangerous wit some good runs e don make down di left flank.
Di Forest defenders so far dey hold firm.
22 mins
What a chance!
Jimenez almost increase Fulham lead.
Di Mexican try one overhead kick just inside Arsenal area.
Fulham now don get corner.
19 mins
Raul Jimenez don collect yellow card for im tackle on Saka.
18 mins
Arsenal dey put beta pressure on Fulham wit some dangerous balls into di box.
So far none of dem don go towards goal.
17 mins
United pull one back through Christian Eriksen.
14 mins
United dey try to apply pressure on di ball.
Maybe di pressure too much as Casemiro don bring down Brennan Johnson.