You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Ten-man Fulham hold Arsenal to draw, Man United come from behind to beat Forest

Live-text commentary of Premier League matches wey involve Arsenal v Fulham and Manchester United vs Nottingham Forest

Live Coverage

Moseph Ekine

  1. Goodbye

    Na here we go end today live coverage of di Premier League.

    Matchday three witness plenti drama as Manchester United come from behind to win again for Old Trafford.

    Dia rivals Arsenal meanwhile drop points at home to Fulham as dem draw 2-2.

    Full Time results:

    Arsenal 2-2 Fulham

    Man United 3-2 Nottingham Forest

    Everton 0-1 Wolves

    Brentford 1-1 Crystal Palace

  2. FULL-TIME - United take all three points, Man Utd 3-2 Nottingham Forest

    Referee blow e final whistle!

    Manchester United come from behind to defeat Nottingham Forest.

  3. FULL-TIME, Arsenal 2-2 Fulham

    10-man Fulham hold on to draw Arsenal.

    Di visitors go dey happy wit dia one point afta dem hold on until di end.

    Meanwhile Arsenal perfect start to di season don come to an end.

  4. , Arsenal 2-2 Fulham

    90+7 mins

    Meanwhile Arsenal still dey try to break Fulham down.

    Di Cottagers almost snatch di lead through Traore wey race down wit Saliba close by. Im still shoot e shot but Ramsdale save am well.

  5. , Man Utd 3-2 Nottingham Forest

    90+5 mins

    Rashford go close to scoring for United as im weave into di Forest defence.

    Im find way to shoot but Turner save am well.

  6. , Man United 3-2 Nottingham Forest

    90 mins

    Meanwhile Forest look dangerous through Elanga.

    Di former Man united man run down di right before e come send cross wey nobody fit connect wit.

    Eleven minutes added time na im remain.

  7. SUBSTITUTION, Arsenal 2-2 Fulham

    90 mins

    Arsenal make dia final change as Jesus come on for Declan Rice.

    Nine minutes na im di ref don add before full time.

  8. GOAL, Arsenal 2-2 Fulham

    87 mins

    Joao Palhinha don equalise for Fulham.

    Di midfielder coolly connect wit Reed corner to draw di side wey dey down to 10-men level.

  9. SUBSTITUTION, Arsenal 2-1 Fulham

    83 mins

    Arsenal boss Mikel Arteta wey don receive yellow for dis match make im fourth change.

    Jorginho don come on for Odegaard.

  10. RED CARD, Arsenal 2-1 Fulham

    83 mins

    Calvin Bassey don chop red card for Fulham.

    Di Nigerian wey dey on a yellow prevent Nketiah from running free towards goal.

    Na im second yellow of di match.

  11. PENALTY - GOAL by Fernandes, Man United 3-2 Nottingham Forest

    75 mins

    United win penalty through Rashford.

    Bruno Fernandes na im go take am, e shoot am hard and into di net.

  12. GOAL, Arsenal 2-1 Fulham

    73 mins

    Nketiah give Arsenal lead for di first time.

    Fulham protest say di goal no suppose count as dia defender bin dey down.

    Vieira slide through beautiful cross for Nketiah to tap home and give di Gunners di lead.

  13. GOAL, Arsenal 1-1 Fulham

    70 mins

    Afta VAR check weda Viera bin dey offside, Saka step up an send Leno di wrong way.

  14. RED CARD

    67 mins

    Forest down to 10-men.

    Joe Worrall bring down Martial.

    As di last man wey deny goal scoring opportunity di ref no get option dan to send am off.

  15. PENALTY, Arsenal 0-1 Fulham

    67 mins

    Arsenal win penalty as Tete bring down Viera.

  16. YELLOW CARD

    62 mins

    Aina take one for di team as e stop United attack.

  17. , Man Utd 2-2 Nottingham Forest

    55 mins

    Antony go close to giving United di lead, good save from Turner.

    Di American stretch well to palm Antony curling shot out.

  18. GOAL, Man Utd 2-2 Nottingham Forest

    52 mins

    United equalise through Casemiro.

    Good freekick in towards Bruno Fernandes wey head di ball back to Casemiro to tap am into empty net.

  19. YELLOW CARD, Arsenal 0-1 Fulham

    50 mins

    Calvin Bassey receive yellow card for time wasting.

    Di defender dey take im time before e take goal kick.

  20. , Man Utd 1-2 Nottingham Forest

    46 mins

    Straight from di restart United almost concede again.

    But di defence block di shot well.