Trump Hail Tinubu - But how well Nigeria military don do for dia fight against terror?

Bola Tinubu and Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images/EPA

Published
Read am in 5 mins

US President Donald Trump don hail Nigeria President Bola Tinubu "decisive leadership" and tok say na "true honour to stand wit you for di fight against terrorists".

Dis na according to exchange of letters betwin di two leaders, wey Bayo Onanuga, di tok-tok pesin for President Tinubu, reveal for one statement on Wednesday.

"I applaud your resolve to tackle di issues wey dey worry your nation, especially di violence affecting Christian communities," Trump tok for di letter, and e promise to continue to support Tinubu for im effort "to make di Federal Republic of Nigeria stronger and more prosperous".

Trump write: "We both share a mutual goal of confronting terrorism for all its forms, and our historic US-Nigeria 2026 Defence Cooperation Roadmap don establish robust framework to accomplish dis feat.

"I dey proud as I bin deploy di United States Special Operations Forces—among di most elite military units anywhere for di world—to equip di brave men and women for di Armed Forces of Nigeria wit di skills, tools and intelligence wey dem need to protect una homeland and make sure of di safety and security of citizens, particularly dose of faith wey bin dey unda attack."

Rememba say on Christmas Day of 2025, di US army bin conduct airstrikes on top some terrorists location for Sokoto State, northwest Nigeria, targeting di base of di Lakurawa terrorist group, according to wetin sabi pipo talk.

Since den, di Nigeria army wit joinbody by di US military don carry out some ogbonge operations for di northeast to clear out Boko Haram, Islamic State and Al-Qaeda terrorists for di region.

Here na some of dem:

May 2026 - Abu-Bilal al-Minuki

On May 16, di joinbodi troops of di US and Nigeria forces kpai di "second in command of IS for di world" Abu-Bilal Al-Manuki, also known as Abu-Mainok, for one military operation, according to wetin President Trump tok.

"Tonight, at my direction, brave American forces and di Armed Forces of Nigeria flawlessly execute a well-planned and very complex mission to kill di most active terrorist in di world from di battlefield," Trump write for im Truth Social post.

President Tinubu also tok say: "Our determined Nigerian Armed Forces, wey work closely with di Armed Forces of di United States, conduct daring joint operation wey deal heavy blow to di ranks of di Islamic State."

Di IS leader kpai togeda wit plenty of im fighters inside di "precision operation" wey be product of "US - Nigeria partnership and intelligence sharing efforts", di Nigeria military later tok.

June 2026 - Two Iswap commanders surrender

Ismail Mohammed and Abu Umar, Iswap fighters wey surrender to Nigeria forces on June 8

Wia dis foto come from, Nigeria Army/X

Two high-profile Islamic State West Africa Province (Iswap) commanders, Ismail Mohammed and Abu Umar, surrender to di Nigerian Army on 8 June 2026.

Tok-tok pesin for Operation Hadin-Kai, Haruna Sani bin release di statement wia e tok say di two fighters dey undergo appropriate profiling and debriefing procedures,.

"Di two individuals bin occupy strategic positions inside di terrorist hierarchy and bin operate witin di Mangari axis of di Lake Chad region," Sani tok.

"Dia decision to flee and surrender further underscores di effectiveness of sustained offensive operations by troops of Operation HADIN KAI, complemented by precision engagements conducted wit di support of Allied Partners against terrorist enclaves across diTheatre."

July 2026 - Abu Salim Iswap cameraman

Abu Salim

Wia dis foto come from, Nigeria Army/X

Wetin we call dis foto, Di Nigeria army tok say dem kpai Abu Salim on July 12

On Wednesday, di Nigeria army confam say dem don kpai Abu Salim al-Barnawi, wey be notorious Boko Haram/ISWAP commander wey later bicom dia chief photographer and propaganda operative.

Di army tok say dem kpai Abu Salim wen di terrorist bin try to attack one military location last week.

"Abu Salim bin dey eliminated alongside oda members of di ISWAP mobile media team including Abu Umar Khattab and Abu Khalid Usman," di army tok for dia statement

"His elimination na anoda clear demonstration say di sustained offensive operations of Operation HADIN KAI dey yield tangible results. Di loss of such seasoned operatives go degrade di terrorists' operational capability, weaken dia propaganda apparatus, erode dia command structure, and diminish dia ability to spread extremist narratives and fabricate an illusion of strength."

For dat same operation, Di Army say dem identify some foreigners wey dey fight wit di boko haram terrorists, including one Moroccan wey be dia doctor, and one Palestinian wey dey give dem training.

In total, for di second quarter of 2025, Di Nigeria military say dem don kpai about 662 terrorists and criminal elements across national theatres, and capture about 1,084 suspected terrorists, informants, and logistics suppliers

Also, Di Nigeria forces rescue 951 kidnapped citizens during clearance operations.

Di comments inside dis letter wey Trump write to Tinubu na turnaround from wetin e bin tok for late 2025 wia e accuse di Nigeria govment say dem no dey do anytin to stop di "Christian genocide" wey dey hapun for parts of di kontri.

Trump bin warn dat time say e go invade Nigeria "guns ablazing" if di govment continue to dey watch di killing of Christians and no do anytin.

Di Nigeria govment deny di accuse dat time and tok say di insecurity situation for di kontri no be mata of religious persecution bicos both Christians and Muslims dey suffer am.

Di US military go later deploy more dan 200 troops to Nigeria to assist di kontri anti-terrorism campaign, but di Nigeria Defence Headquarters tok say time say di role of di US soldiers na majorly for intelligence gathering and support, no be ground combat operations.

However, recent tori be say di US troops don dey withdraw from Nigeria, even though di Commander of di United States Air Forces for Africa, General Dagvin Anderson, tok say di two kontris go continue to share intelligence and support operations against IS fighters.