You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Give me her deadi body, I no want autopsy' - Mary Habila papa counter Umahi
Family of Mary Habila wey kpai for di residence of di Minister of Works for Nigeria, Senator David Umahi don tok why dem no want do autopsy for dia late daughter.
Dis dey come afta di Minister of Works for Nigeria, David Umahi break silence ontop di death of Mary Habila on Thursday for press conference.
Na di first time di minister bin tok officially on di mata wey don become national tok-tok.
Di minister for briefing wit tori pipo for Abuja on Thursday say evidence boku about how Ms. Mary die but di family say dem wan correct sometins about dia late daughter.
Meanwhile, one lawyer wey identify imsef as Barrister K.A Yusuf and lawyer to di family of di late Mary Habila tok say di family need to clear di air about sometins, especially wetin Works Minister, David Umahi bin tell tori pipo on Thursday.
E say some of di tori wey dey fly upandan no be true, na false allegations about who she be and her character.
"Late Mary Habila no be physiotherapist, she be nurse wey dey work for Umahi University of Health Sciences, bifor dem move her to him office and she don dey work wit am for three years."
Di lawyer say if no be say dem wan protect her privacy dem for show her employment letter and payslip to show say she be civil servant.
One of di issues im raise na how police for Ebonyi State no wan release di deadibody of Mary Habila for burial afta dem don do evritin wey di police tell dem to do.
"From all indications pipo wan use her a pawn for all dia political manuover and manipulation just to score cheap political goal and we dey her to also confam say di minister don request many times make dem do autopsy on di late Mary Habila but di family don determine and still dey stand on dia ground say dem no go allow am becos of some personal, cultural and traditional reasons."
Barrister Yusuf make am clear say dilate "Mary Habila no be runs girl and she bin dey Abuja since dey work wit di minister bifor her eventful death, dis na di truth."
Im tell tori pipo say as dem neva give dem di deadibody, di family tell am to write petition against di Commissioner of Police for Ebonyi State and send am to di Inspector General of Police make dem release her deadibody.
According to am na on 27 June, 2026 she die and e don dey reach three weeks now and di Commissioner of Police no gree release her deadibody without any beta reason.
'I no want autopsy I want her deadibody' - Habila papa
Papa of di late Mary Habila, Mr Tanko Habila Wisdom, tell tori pipo say wetin im want na im daughter deadibody.
"For my place we no dey keep deadibody of small pikin like dis, na why I dey tok again say I need di deadibody of my daughter, I wan bury her now. I no want autopsy I want di deadibody of my daughter, I wan bury her now"
Im tok say di relationship between im and im daughter dey veri okay both for her working place, for im house and evriwia.
Im explain say im no dey suspect anybody sake of say death fit happun anytime.
"As we dey stand here now anybody fit fall down die so we no dey suspect anybody, e don happun already"
'Mary Habila na like daughter to me' - Minister Umahi
Oga Umahi wey pipo dey drag for social media sake of di death of im staff for im house tok say Mary boyfriend bin don also reveal wetin e discuss wit di woman before she die.
E say im don order make dem do autopsy to really find wetin kill her.
"I hear say di family tok say autopsy dey against dia tradition but dis na serious mata wey get medical history and na autopsy go fit reveal wetin really happun to her," Umahi tok.
Earlier di minister tok-tok pesin, Francis Nwaze tell BBC say di minister wan make dem investigate di matta to determine wetin be di cause but di parents of di lady no gree.
"I don make press statement on dis matta to clarify say im get interest in autopsy but di parents of dis girls don insist say e dey against dia cultural believes, " Nwaze tok.
E add say Habila na employee of di David Umahi Federal University Teaching Hospital, she die on June 27 wen she bin dey on attachment wit di minister medical team.
Umahi during di press briefing on Thursday, e tok say bifor she die, she tell her boyfriend say she dey bleed for nose.
Di minister tok say afta she tell her boyfriend, e advise her make she report am to her boss but she later tell am say di bleeding do stop.
"She tok to her boyfriend bifor she die, complain say she dey bleed from her nose, and di boyfriend tell am, No, you need report am," Umahi tok.
"She tok say e don stop. So di boyfriend tell am, Listen, I no go fit continue dis tok since you dey bleed. E go make di bleeding increase. She tell di boyfriend, No cut di call. Di boyfriend cut di call, and three minutes later, di boyfriend call again. She no dey respond."
Umahi tok say na her colleagues find her lifeless body di following morning afta dem no fit reach her.
Di minister tok say dem forcefully open di door to her room and find her lifeless body.
"She lock her door. So wen dem discover her for morning, dem break di door and see say di tap still dey run. Wetin dey baffle me for dis country be say everitin dey turn opportunity."
Umahi don warn pipo make dem no use di news about di death of Ms Halida to "dey play politics."
Wetin we know about Mary Habila death
For June news bin break ova di death of 26-year-old, Mary Habila for David Umahi Federal University Teaching Hospital for Ebonyi State.
On, June 27 tori be say Mary Habila wey hail from Kaduna state, die for David Umahi residence.
Di nurse wey dem attach to di minister medical team travel go Ebonyi state bifor her death.
Netizens don call for thorough investigation into di circumstances wey surround her death afta di foto of her lifeless body bin trend online.
Political activist Omoyele Sowore call for coroner inquest into di circumstances wey surround Ms Habila death for di minister residence.