Andy Burnham start work as new UK Prime Minister

Wia dis foto come from, Dan Kitwood via Getty Images
Andy Burnham don replace Sir Keir Starmer as UK prime minister, afta e bicom Labour leader last week.
Di former mayor of Greater Manchester don bicom di fourth prime minister in five years and di seventh since 2016.
For im first speech for Downing Street, Burnham announce say im go "end rough sleeping for our kontri".
One No 10 press release wey promise extra £340m for di task ova di next five years, quickly follow am.
E also promise new 10-year plan for Britain - wey dem go unveil later dis year - and to build new economy, wey go put "life essentials back under public control".
But e argue say pipo also need "breathing space now", e say announcements on tackling di cost of living go start on Tuesday.
E say dis moment go mark new beginning for Britain and say dia go be one new political model.
E point to wetin e call "wrong turns" wey Britain take for di 1980s, including privatisation and de-industrialisation.
E say many areas never recover from dat time till today, adding say e go change politics to make am more about working together and solving problems instead of scoring political points.
Oda changes e promise include, changing di education system to help young people into work, building more council homes, and honour commitments to fund defence, as e say im go stick to UK spending and debt rules.
Burnham announce new cabinet
One of Burnham first tasks na to appoint ministers, and e don make some changes to di cabinet alreadi.
John Healey na di new chancellor while Ed Miliband become foreign secretary as Prime Minister Andy Burnham appoints im cabinet.
Shabana Mahmood dey reappointed as home secretary, while Louise Haigh na di new Chancellor of di Duchy of Lancaster and member of cabinet.
Shabana Mahmood na one of di more prominent Labour figures since Labour 2024 general election win.
Former transport secretary Louise Haigh return to di prime minister top team, to serve as first secretary of state and chancellor of di duchy of Lancaster.
'I go give evritin I get' – Burnham
Burnham say e go focus on "putting di right values and right standards for di heart of government."
"E go make care for pipo bicom di centre of evritin wey I do," e tok, adding: "I go give evritin I get" to "build one new national spirit of unity."
E beg di public and im supporters make dem stand with am, saying dis na di moment "when Britain go begin believe again – di moment wey hope go return."
Di Prime Minister finish im speech and people clap for am. After dat, e kiss im wife, wave to cameras bifor e enter di famous black door of Number 10.
Wetin be Burnham first tasks?
Andy Burnham don say say im first instruction as Prime Minister go be to "end rough sleeping for our kontri."
Earlier today, bifor e bicom Prime Minister, Burnham visit one homeless shelter for Victoria, central London, to show one of di main tins wey e wan focus on.
As e tok to journalists for di Passage shelter, e say ending homelessness go require evribodi to work togeda.
E refer to di "Evri one In" scheme wey government launch during Covid pandemic and say:
"We do am dat time, we fit do am again now."
E also say di first pipo wey e go call as Prime Minister na US President Donald Trump and Ukraine President Volodymyr Zelensky, adding say UK support for Ukraine go remain "strong and unwavering."
When journalists ask am about anonymous negative briefings against Energy Secretary Ed Miliband, Burnham say e "shock" am and insist say im team no get hand inside am. E promise to bring respect and teamwork back into politics.
E also say e know say na another Prime Minister joining di long list of leaders wey no stay long for office, adding:
"Dat no good enough – we need do better, and we go do better."
'I dey leave wit smile': Starmer leave Downing Street as pipo clap for am

Wia dis foto come from, Anadolu via Getty Images
Starmer say as im time as Prime Minister end, di economy don bicom stronger, public services don improve, more pikin don comot from poverty, immigration don reduce and Britain's international reputation don improve well well.
But e say di tin wey e go remember pass, di "most humbling part" of di job, na di opportunity to witness di best tins wey dey happun for di kontri.
E say e see am through pipo wey dey serve di country, whether na military personnel, NHS workers or people wey dey serve dia communities.
"We dey face one world now wey our enemies no go stop at anytin to divide us bicos of our values," e tok.
Under dis kind attack, e say e "very important" make pipo remember "di greatness of Britain wey dey all around us."
Afta e waka come outside as pipo dey cheer and clap loudly, Starmer begin by saying say e dey go meet King Charles III to officially submit im resignation and "close di book on my time as Prime Minister."
"My work don finish," e tok.
E say na "di greatest privilege of my life" to serve as Prime Minister and say e believe di kontri now "stronger and fairer" than e be two years ago.
As e dey hand over power to Andy Burnham, Starmer say: "I wish am every success. E get my full support."
E tank im wife, im family, im team across Labour Party, everybody for Number 10 and across di civil service.
"Politics go always be team work," e talk. "And I thank di British people for giving me di opportunity to serve."
Starmer end im speech by saying, "I dey leave wit good grace, I dey leave wit smile, and I dey proud of evritin wey we achieve."
Afta pilo wey gather clap for am, e enter motor go Buckingham Palace.

Wia dis foto come from, Anadolu via Getty Images
Almost one month afta dem swear am in as Member of Parliament, Andy Burnham become di new Prime Minister of di United Kingdom on Monday.
Burnham appointment na di end of one dramatic 10 weeks for Labour Party, afta di party perform very badly for local elections for England and parliamentary elections for Scotland and Wales back for May.
Afta e assure pipo say e go remain for office, Prime Minister Sir Keir Starmer announce on 22 June say e go step down – four days afta Burnham win Westminster seat.
Starmer resignation lead to one leadership race wey later turn to one-candidate race for Number 10, as 379 Labour MPs nominate di former Greater Manchester mayor to bicom di new party leader and eventually di new Prime Minister.
Who be Andy Burnham di ex-Manchester mayor wey fit succeed Keir Starmer?

Wia dis foto come from, Dan Kitwood via Getty Images
Dem born Burnham for Liverpool for 1970, and e go grow up for Culcheth, one quiet commuter belt village for Cheshire, near Warrington.
Im papa wey be BT engineer, and im mama wey be GP receptionist na strong Labour supporters and e develop early interest for politics.
Burnham don describe how im bin dey inspired to join di Labour Party at di age of 14. E say na BBC TV drama, Boys from di Blackstuff move am to join as e dey about life on di dole for Liverpool.
E be Everton fan for life. Burnham friends sabi am as competitive, sports-mad pikin, wey be fast bowler for Lancashire schoolboys cricket team.
Burnham plus im two brothers na di first pipo for dia family to go university. E study English for Cambridge.
For im book, Head North, Burnham bin write say im "struggle to feel part of tins" for university and im bin feel like "imposter".
However, di music-lover – wey be fan of northern indie bands like The Smiths and The Stone Roses – tok say im "growing interest for Manchester music give am identity and advantage".
From MP to Greater Manchester mayor
Afta e graduate, e begin work as journalist, e work for trade magazines including Tank World and Passenger World Management.
For im early 20s, e get im first break in politics, e work as researcher for di late Tessa Jowell, then MP for Dulwich and West Norwood, wey go later go on to be minister under Tony Blair and Gordon Brown.
Despite im later hatred for Westminster politics, Burnham rise quickly through di ranks. E bicom special adviser to Culture Secretary Chris Smith bifor e dey elected as di MP for im hometown of Leigh, for Greater Manchester, for 2001.
E bin first serve as junior minister under Blair, but e join di cabinet as chief secretary to di Treasury, and later culture secretary and health secretary, under Brown.
Na as Secretary of State for Culture, Media and Sport, pipo boo Burnham during one memorial service wey dem do to mark di 20th anniversary of di Hillsborough disaster.
Ninety-seven Liverpool fans bin die for di stampede wey happun for stadium for 1989.
For 2010, Brown resign afta Labour Party lose for di general election. Burnham bin run to bicom di party leader.
E come fourth out of di five contenders, e lose to Ed Miliband but spend di next five years dey build up im appeal wit di party grassroots.
For 2015, e try again, but Jeremy Corbyn defeat am.
Pipo wey dey criticise Burnham don label am 'weather vane', dem say e dey change im views as di political condition dey change, just to give am beta chance to succeed.
E serve for Corbyn shadow cabinet, as shadow home secretary, even though dem see am as Blairite centre-right of di party.
Burnham views don move to di left, as e back di nationalisation of water and energy.
E no dey part of di pipo wey resign in protest for Corbyn leadership for 2016.
Instead, e stand down for 2017 to run to be di first mayor of Greater Manchester.
Burnham win di contest wit more dan 60% of di vote and e dey re-elected by even bigger margin for 2021.









