Wetin we know about di jihadist ambush wey kill 50 sojas for Mali

Wia dis foto come from, Samir Maouche / Hans Lucas / AFP via Getty Images
Tuareg separatists and jihadist fighters ambush di convoy of Malian army wey lead to di killing of at least 50 sojas.
Di Malian Armed Forces describe am as one of di deadliest attacks in years wey large number of sojas go die.
Di ambush on di army convoy happun for Gao region, one of di regions for northeastern Mali.
Reuters say di militants wey carry out di ambush dey linked to al Qaeda and Tuareg-led separatist group wia dem kill allied Russian fighters alongside di sojas.
Di attack happun ova di weekend on 18 July, wit at least 50 sojas killed and dem capture dozens of Mali army (Fama) and Russia Africa Corps.
Report say separatist Azawad Liberation Front (FLA) claim responsibility for di attack, and dem call am major defeat for Fama and Africa Corps.
Di FLA-JNIM attack for Gao come wen pipo dey tok about geopolitical tensions ova foreign involvement for Mali conflict.
Di attack mark di latest of series of assaults by di two groups, wey don dey launch attack for Mali since April.
Rememba say for April, explosions and plenti gunfire bin go off for Mali capital, Bamako.
Di attackers carry soldiers go different parts of di city and dem block roads way dey lead to di area.
Na di attack lead to di death of Mali defense minister, Sadio Camara, wey family say kpai for suicide truck bombing for im residence near di capital Bamako.
Wetin we know about latest attack for Mali
Di attack wey happun for Saturday for di city of Gao na between di Azawad Liberation Front (FLA), and di al Qaeda-linked group Jama'at Nusrat al-Islam wal Muslimin (JNIM), according to statements from Mali armed forces.
Mali army say di ambush happun around Tabrichat area of di region and dem launch retaliatory airstrikes.
Di FLA also release statement wia dem say "dozens" of Malian sojas and members of di Russian paramilitary Africa Corps dey "neutralised" and damage dey.
Malian army say dem launch airstrikes wey help di convoy reach di city of Gao and kill "several terrorists".
Di army also say dem hit JNIM-FLA logistics base for neighbouring Timbuktu Region, wey kill several fighters and destroy fuel supplies.
Di Malian Armed Forces (FAMa) say di precision airstrikes neutralised around 20 fighters, destroy four pickup trucks, and clear three enemy positions near Tabrichat.
For early July, Mali army say dem kpai several armed militants wey attack dia military positions for some parts of di kontri ova di weekend.
For dia statement, di army say di attack affect five cities wey di militants target.
Di militants bin attack locations like Alguel-Hoc, Anéfis, and Goa for di northern part of Mali, Kenioroba for di southern part near di capital Bamako, and Sévaré for di central region.
Tuareg separatists from di Azawad Liberation Front (FLA) say na dem dey responsible for attacks for three of di locations wia Malian troops and Russian paramilitary troops from Africa Corps dey.
For June 2026, Mali junta govment place bounty of 2 billion CFA Francs (about $3.5 million) on di head of Iyad Ag Ghaly, leader of di deadly Sahel jihadist group JNIM, for im alleged involvement for terrorism.
Di move dey come afta April coordinated attacks by JMIM militants and Tuareg separatists from di FLA group, wey kill Defence Minister Sadio Camara.
According to statement from di Security and Civil Protection Ministry, wey dem read on state television on Thursday, dem also name six oda rebel leaders on di same wanted list, including one of Ghaly deputies and two FLA officials.
Dem announce separate financial rewards for information wey go lead to dia capture or killing.










